Sunday, October 28, 2007

Marriage fever in town.


My people, wetin dey happen for naija...abi this na world wide virus. Everytime i dey chat with my friends especially the ones for naija..na so so "which time u go marry be the question dem go dey ask me"..ah ah..na waoh..wetin now...na so person dey take marry. Just becos persin finish school, come dey work na wife be the next thing...i don tire o. If to say persin don ck old age..ehen...then discussion...which kain tin be this.

I just dey wonder whether dat na the new measure of social status...abi na which kain tin be dat one. Dem go dey point out all the people where don marry....no wahala...no be persin where start first dey finish first...dat is if destination dey inside marriage..i don wish dem good luck and give them my blessings...lol..na waoh... Man,I come dey think of wetin some naija women dey go thru if dem neva marry...papa go call...mama go call..everybody go dey call the poor girl say make she go marry...lol..man, women dey try o...cos all these few harassments don tire me ...not to talk of women and dat one na from all angles. Chikena...make una free me. Persin where wan go marry make e go marry..me, i go do am without any pressures...

If the persin wan become baba ibeji tomorrow..lol..no wahala, na your wife. Abeg, make this marriage fever no grip me, because I go vex for persin. No be say persin go settle down when im don old finish, but na at the right time.

On anoda note, i hear say american visa lottery don come out again...so make every where wan come america go apply...i don tell my brother say I don tire for dat visa lottery..na since 1988 na im my people don dey apply yet no body close to me don win...which kain tin be dat one..lol...na so we take get bad luck....ah ah...right from the days before internet na m we don dey apply...lol...anyway sha, i know say people dey win..so good luck to everyone.

Anyway sha, my people how una dey..hope say every dey kampe !! Make una get a good week without any "go marry" fever...lol... Abeg, if you sabi any better place to chill out for Vancouver canada, abeg make u holla me..i need to know the right places to check out when i enter dat side...i go tell una about my doctor's (abi na veterinary's) visit last week, dat one na anoda funny tory...the kain tins where my eye don see...peace out folks !!

5 comments:

cally-waffybabe said...

Shoo? What is it with dudes and marriage posts recently? LOL. Went to Atuts and Naapali's, same talk.
Oya Ozy, go marry make you hear word...

Ozymandias said...

@CWB: haahah..how much dem dey sell am..dem dey accept credit card..lol

Yankeenaijababe said...

There would always be that pressure on we Naija peeps to marry especially ladies. U know when u start reaching 26, 27,28...ah na different storie be that. I won't forget my mum telling me that she has big plans for me. Am like what? Me ke hook up with some dude for Naija. lai lai. loll have a class now. l will sure be back.

Ozymandias said...

@YNB: lol...come'on..hooking up with a naija dude ain't bad..lol..no forget send invite when those big plans shele o..

Jamilah said...

lol.funny