Monday, August 13, 2007

E no easy !!

My People, today has not been easy o. Infact if not for the vegetable soup where i dey think of the entire time for office, I for don sleep inside my cube..tay tay..lol !! Anyway sha make una see wetin happen o. For dat kain 3pm, na im sleep come dey catch me as I don finish wetin I wan do today, na im I come remember the vegetable wey I get for fridge...ummh...small time na im my mind just remember my mama soup for Nigeria....ummh...na so wahala begin o. I just begin to design and implement my soup for my mind....lol...no do, no do...na im my mouth begin water....omo e tough o. Na im I come see say I no go fit siddon here, na im i go raid the pantry for my office...go get small food chop for there...lol..

As I come dey come back, I come remember say I no get pepper for house when I don come down from the train....i talk for my mind...NEVER..omo, na so I waka 10 blocks o...thats 20 blocks to and fro...all for my vegetable soup. Anyway sha, my vegetable soup don set....and as I dey smell the thing from dis place ehn...once I knack that soup...na better sleep be dat o..lol. You see, the way where I dey take cook my food ehn...e too much..lol..no seriously...no be joke o...lol...even my friends dey tell me say my wife no go need to cook..lol...me, I no mind o, i dey enter kitchen anytime. Infact for house, na so me and my mama dey fight for her kitchen....na so she go dey pursue from her kitchen..lol...see wetin dey, for me cooking be like chemical engineering, put all the ingradients in the right proportions and better food don shele..lol...just like chemical reaction...As for me o, the main thing na to make sure say u season your meat well well..me i dey add every..basil leaves, oregano leave,s parsil, italian seasoning, salt, etc....and once the meat dey well seasoned, better food don shele. ...this one no be Ireti catering practical o...this one na ogbonge soup....lol

My people, all na chemistry o...lol...the meat + better seasoning = nice taste...and the other part of the cooking, na the secret of my cooking!!!...I no fit reveal am here..if you need the recipe, send me email along with your $$$$..lol....and na only paypal I dey accept o...pele!!, I no dey accept credit card...anyway sha, e be like say my soup don ready o....una dey smell am for there....lol..e don tay where i chop this kain food..abeg, make I go chop o, before I drown inside my saliva for here..lol...ahh, I remember "mama zing ting" for uniben, guys survive on that woman o in those days....na so we go dey chop this woman soup with enough water and na so we go dey fight with flies with one hand..e no easy..lol..my people, i dey invite una o...make una come follow me chop......no be say una go come o, una go say thank you.....lol...peace out ppl !!!

2 comments:

Onada - Fashion and Photography said...

LOL you are hilarious!!! I hope you got to enjoy your soup! Give me the recipie now....

Anonymous said...

Amiable brief and this fill someone in on helped me alot in my college assignement. Thanks you on your information.