Thursday, November 22, 2007

Police story 1.

My first encounter with the police, naija police, was thankfully not dat bad...if to say dem catch me dat day, the kain bullala where I for get ehn...my back go still dey pain me reach today...lol

Back in secondary school abi na high school...you see I went to this area sec. school where the number of peeps where sabi speak yoruba for class pass those where dey sabu english for class...lol...I no no which category i dey sef..if dem leave me ehn, na for yoruba i go dey write dis blog...kilo wi, se o ri gbo ibon to ti fe she eniyan le she..lol....figure that out and you get a free T-shirt with my face on it..lol... Infact, i fit count the number of peeps where fit speak anglais without adding ngbati-ngbati to the sentence,,..man, dat ma school na waoh.....hmm, maybe dat na why I just dey throw way bullets for dis my blog....lol..

Anyway sha, as I dey talk. One day, na im we dey class with nothing to do...me i siddon one corner dey jack my "Better lover" for class...lol..which kain book persin wan read nah, dat na the most important tin at dat time. So me i siddon jejely dey jack my tin..dey dream dey go...lol..na im some olopa, abi na police dem dey call them come park their vehicle on the street dey collect egunje abi na bribe as usual. You see, my class dat time dey on the first floor facing the road.. so my classmates, who obviously had nothing to do come dey look dem as dem dey collect the money with dexterity..lol, make I blow small grammar nah...free me, e don tay where i blow grammar for dis my blog....lol.Dem go hide the money for one secret corner...lol...reminds me of a naija comedy now. So na im one of these guys where dey sell Buns abi na puff-puff ..lol..i no even sabi...come dey waka pass, na im dey police men stop this guy...dey ask am of licence,..just kidding..but I'm sure naija police can do that...lol

Seriously, wetin concern this police men with persin where dey sell puff-puff...na im dem wan collect "something" from the guy. The guy come dey resist, and people come dey watch dem..but trust naija now, everyone mind im business. My classmates come begin dey shout from window "Give am one puff-puff", "Give am one buns", "Find olopa one buns or puff puff", "Fun won puff puff jare"....lol...people where dey for street just dey laugh the police men...omo, shame just catch the police men...lol. Man, before we go talk Jack robinson..the police men vex..turn round...enter my skool...lol.come find us.


Man, see race..the entire class empty....lol..me, where dey jack better lover,...no be persin tell me make i find my way...na so I carry my pigolo where don stand under my desk take off...lol...if too say woman dey my skool, and i carry dat tin chook am at dat time..lol...dey girl go just carry belle...lol..and na quintuplets e for born..lol Anyway sha, na im we take of and when olopa enter my class, na only one guy where dey sleep na im dem see...man, dem vex o, no be small. na im all the teachers, principal come dey beg for almost 45 mins....man, if to say dem nab anyone of us...e for rough dat day...de kain bullala ehn, maybe dem for carry us go their station do throw way us inside cell with hardened criminals...shivering...dat one for rough o..lol...

Tory neva end o...after the police men waka, na im dem come dey find the people where cause the problem. Na im i come carry my big mouth go tell my pal say na Femi be the ring leader....omo, na im my pal go tell the teachers say Femi be the ring leader just to save our necks. When dem come catch Femi, im come name all him accomplices...guess who he named first...lol..Me !! just to punish me. All my explanations fell on deaf ears...na so i take enter wahala...kai..I don learn my lesson with snitching....but no be me tell the teachers...I just tire. Na so i enter wahala, dem give us cutlass...omo, na so we enter bush for dry season go cut grass...when the grass don dry ehn....i nearly die...na so dem sentence us to 7 days of grass abi na bush cutting..lol. Man, after the first day, i nearly die out of annoyance. I curse Femi die...and unluckiliy for me...I was the only innocent one..so to fight am no be option at dat time, all of dem go just join hands wound me join..lol..

Anyway sha, on the second day, the teacher in charge of punishments..one randy useless teacher like dat say make we go find one of him girlfriends for the next school for am...lol..dis na secondary school girl o...say if the girl gree, im go free us. Na so we go find the girl, beg am say im sugar daddy wan see am..and the girl gree...lol...and na so the man free us o. Thinking about all that now, i can't help but be filled with digust that my secondary school teachers were sleeping with their students....After dat experience, i learnt my lesson...Me and naija police no dey follow one way..but na lie, me and dem go still jam again....and i hate them for everything they are.

Abeg, make i go sleep...peace out folks. enjoy your day !!

7 comments:

Unknown said...

Funny! Why you mess up and like Liverpool-that's the team i hate- after Man U of course...

My pidgin english is rusty na so i use agidi to read your story o...

Jamilah said...

hahahaha..omg.. funy ish esp using pidgin..lol..
poor you... i can just imagine how disgusted and annoying yu would ave been.. but i liked mass punishment in school sha.. it was the best..
omo that yoruba i got it o..hmm il go back and read, so u better be getting ready to fedex a shirt to me.. wid yur face.. wow.. u berra be cute..lol...lol.
nice one.. how did your holiday go... we were battling wid typhoon treats here while y'all were busy chewing turkey..
nice post..
i'm good o.. i shuld even update sef.. thanks for checking on me..

Jamilah said...

kilo wi, se o ri gbo ibon to ti fe she eniyan le she

wat did yu say, se yu didnt see all the ibon( guns,bullets, )that wants to injure person( yoruuba english..lmaoo)

oya fedex my shirt o :p

Ozymandias said...

@omo-obanta: I can see that truly your pidgin english is "agidi"...but no prob. Too bad about the Liverpool bit...maybe i can convert you..lol
@bibi:lol..i can't believe you actually figured out that yoruba in spite of how rusty my yoruba is...I'm impressed with myself and right now I'm doing the moon walk for that..about the shirt..hmm..send me ya address..

Jamilah said...

i'm yoruba now

Anonymous said...

viagra uk cheap purchase buy viagra online cheap viagra sales viagra discount womens viagra where to buy viagra viagra cheap women does viagra work which is better cialis or viagra viagra free trial cialis super viagra free sample pack of viagra viagra sales buying viagra online in britain

Anonymous said...

top [url=http://www.001casino.com/]casino[/url] check the latest [url=http://www.casinolasvegass.com/]free casino[/url] unshackled no set aside hand-out at the best [url=http://www.baywatchcasino.com/]casino games
[/url].